Struggling Masses and Funny Elites (Pidgin Poetry)

631
Spread the love

E don tey !

Wey we dey this struggle,
Yet the nation never bubble.

This shaky colonial framework
Don tire to dey suffer
From the hands of bloody maga
But e be like say we self no bother
Yet, we dey work harder
Like shade dey tell ade
On top bed, say make he go harder!

Help us ask our landlords na
The greedy servants messengers
Why dem no dey see beyond
Their stomach?
Dem forget say soldiers must retire
Either he like am or not
The grave must chop am.

We get cocoa
Where the chocolate dey?
Shebi,we get oil
Why oyinbo dey sell am give us?

Our pikin dey change gears
From hustlers to traffickers
See the road to Libya,
The populace na from Naija.

Education no get meaning
Ask Folake,
she go give you her reasons
How she trade her virginity to get a pass,
She be no want do oooo!
But the oga give her condition.

See us as we dey thrive now!
Surviving with conditions
Graduating with conditions
Jobs with conditions
Trek the street, if your papa  no get position.

“We go address and redress”
The situation
Mr lai is ready to tell us a lie
This na the change?
Abeg tell us say na game.

We believe in una drama
We dey see the fake trials
How you swings from broom to umbrella
How you employ animals
To become the modern day looters.

How a lawmaker turn to a singer,
How that bros want to be an emperor
Make his son -in-law a governor.

Make una no forget
dem dey fight corruption
Yet, certificate fly through backdoor to frontyard

No be true,
Paper dey lie
The video was doctored
Case of the Kano leader.

Oyinbo no tire to dey watch our game
Them say we be terrorists
Dem say we too corrupt

Say, for our industries,
We no get experts
Dem say we too dull
We dey import everything

How come we no dey learn?
Correct our mistakes
Avoid the heart breaks

Yet I dey hear Atikulate
From another side,
I dey hear Buharist

Naija no still dey make sense
Even with the new minimum wage
Let us correct our sensuous
I mean our sense
I hope say you get?

Another election is near
Shame the shame
Chase them away
Your vote get power pass wetin you think.

God bless my country

A Sincere Nigeria is possible!
You and I can make it happen.

– Emmanuel Balogun
07034444976


Spread the love



Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *